Na im one day i carry my car commot for
house,
As i dey go na im i see one man dey shout.
'Stop there, stop there', he dey tell me,
Wetin concern me; i don go!
Na im wen i come dey come back
Na im kasala kon burst.
For morning, na only one man,
But now, you go think sey they import them.
Dey don block the road,
You go think sey na boko enter.
'MUS-317DM, stop! '; the same man shout,
'What's this? ', for my mind i dey blow
grammer.
Na im the same man, show face.
Face wey be like prayer point.
You know how you dey pray for money na,
Na so the man dey shine face for me.
For my mind, 'Allahu', 'Oh God', na
Im i dey talk.
Before i no am, the man don shadow me,
With kumo* before my glass.
'Ko ju ma ri bi gbogbo ara lo gun ee'
Na im i jejeli slow down for them.
'Where is your particular', the man dey shout,
As if sey, particular go do am.
I give im paritcular but he no gree,
Na then i no say 'to be a man is nor
enough'.
Na im i come start to beg,
The guy no gree oo, like sey we get beef.
Na later i come know wetin he want,
But seriously, i know get kpanyi for wallet.
My guy no believe oo, he even
Tell sey make i bring my A.T.M card,
If i no get cash for hand.
'Eeh! ', na then i no sey the matter don red.
Wetin we dey talk? , he commot POS
From him pocket.
But, as omo agabandi,
I commot money give my 'padi padi'
Chai diaris God ooo.
c.2017
Written in Nigerian's pidging English.
This poem has not been translated into any other language yet.
I would like to translate this poem