Abeg my people
Who fit stop the Sun
Make he no shine hin shine?
Abi na your Sun?
Na Oluwa do am so
You don hear before
Where Babalawo Fly Aeroplane
Because he get Otumokpo
Him science no reach dia
Power pass power
Abeg my Goons
Who know how water
Wey no get enemy
Take enter inside Coconut?
Abeg, who know?
Na only Baba know oh!
Even if you be Bookuru
Read Cambridge join
He no mean say you go get money
Make you go Alaba go see Chukwudi
How many certificate he get?
You get hand
You get mouth
You get everything
You still dey suegbe
Wetin dey work you?
Make I clear you well
Every Mallam to him kettle oh
If you no blow this year
Na your gbege be that
Oyo, na him you dey!
So, wetin I dey talk be say
Make we look inward
See wetin we fit do
Even if certificate no work
Make we find handwork
And Oluwa go bless our hustle
For you Aunty Susu
Make i chop this one money
Chop that one money
I want i-phone 17
Sponsor me go Dubai
Na so Okpo dey take start
Brother Sule
Make you kontinu
Front you no go
Back you no go
Last last, you go hear ram
When jungle don mature
If you don tire
You go swallow something
Na your own finish oh!
The Guy go kontinue him life
The woman go still dey flex
Na you loose, hell fire straight
Oya, receive sense!
Make sure say your hand
And your brain work together
Because this life na race
We must reach last bus stop
All of us must blow scatter
Me I don talk my own
If you like hear
If you like no hear
Our Elders talk say
Jollof Rice wey dey for bottom of pot today
One day he go dey on top cooler oh!
Babatunde Raimi
Author/Life Coach/Poet
This poem has not been translated into any other language yet.
I would like to translate this poem
Looking inward - great achievement