Iglish Langwej Poem by Ekwueme Kelechi

Iglish Langwej

Na modara be in second nem
In don tu pipo
No de tok egen
Som don bikom sef-med dumbs

English tu posue Wuman
Na wai in gree mek dem get
Giv ha ha buk
In no kom gree giv him him buk

Na beta ashawo wey in be
In jos de jump jump
From hauz tu hauz
From French in go jump laik monki

Go Latin, Greek, and odas hauz
Still di tin neva do am

(c)EKWUEME KC

Thursday, June 7, 2018
Topic(s) of this poem: satire
COMMENTS OF THE POEM
READ THIS POEM IN OTHER LANGUAGES
Close
Error Success