Harder, Harder Poem by Raimi Babatunde

Harder, Harder



When you go hospital
Sebi dem suppose dey happy?
Like Tortoise wey drink water
But the story no be here
Especially for Naija government hospital

I no even know sef
Maybe I no go born for Naija
If you go hospital go born now
The story wey I dey hear plenty
I cannot come and kill myself

Make I yarn you their tori
When the water don burst
If you shout kpim
Dem go say "When the thing dey sweet"
You dey shout "harder, harder"

Which one be "harder harder"
Abi na delivery motivation?
Dem get PH.d for General Hospitals
But sha, dem dey try
Make we just cooperate, push born the pikin
Las las, we go dey alright

Tuesday, October 22, 2019
Topic(s) of this poem: marriage
COMMENTS OF THE POEM
READ THIS POEM IN OTHER LANGUAGES
Close
Error Success