Phone no strong at all
No mata di pipo wey du am
Wai in go wek pesin wey de slip
Bet no fit wek pesin wey don die?
Afta al slip na slip
If tu se in strong
In for de wek pesin
Wey don slip tu much
Phone jus dey bayas
In de wok for pipo wey dey laif land
Bet no de wok for pipo wey die
If tu se in bi Ogbonga
I for don hia mai fada fada tok
Mek I know if dey de chop dia
(c)EKWUEME KC
This poem has not been translated into any other language yet.
I would like to translate this poem